Tuesday, 23 October 2012

baDDest BroS


Bros, You see You ba, you are a very bad guy, badder than Wiz-Kid, Skales and Banky combine in your own level. I sabi why you no wan accept my BBM invite, you just de decline, decline, decline. Bros wetin do new phone? Bros if you buy phone new you go die? Bros is anything wrong with receipt, warranty and carton?


Bros na so you de with your man wey just import(arrive) from Bayelsa, wey hold bills(money) but no trips(trips). You just involve am for one fresh, soft P(waka). Una(youBoth) just burst in Si-Va Bed(silver bird) just dive-in Diamond Lounge, just first pop 1 J.D(finewhisky) first for vision. Una just de feel light Jamz; D.J de perform. Frowning faces few, everybody just de smile and tins. Time de advance calmly into the night. Slowly slowly activities de take place. Den based on ABJ boy, and many Kush(NZT) for blood, you wan tidy one Ovaltine(SureGirl) for your man, make Im just de busy with. Sweet boy, you approach one, give am soft game, appropriately apportion swag; She Flow. Bros dis your man babe get friends oh! Dem smile as you carry dia friend go, so you fit still hold one of dem in the interim, but no, na Alomo(OshoFree) you want, na so you waka(walk) go meet one quiet girl de talk-soft for her ear. She just collect your phone to put number, after much persuasion. she press 0703303...the 3 no enter well, she try, try, try; immediately e(it) occur to her say na so her BB wey loss de mental(malfunction) 'OMG, this is my phone'... so as you notice the difficulty in her putting her number you offer to help, unto owner of handheld. She say 'where did you get this phone' your mind cut, chei!!! 'I say where did you get this phone?' See people de look you Bros, na Im she begin shout, de call her friends, say you be tiff(thief). Everybody de look you like MTVbase(mtvbase)


Bros again you no stop, you still go tidy street(illegal) Bros na 2nd Hand phone put you for wahala, wey you go accept invite wey person send, you de feel confi, she put soft-pictures for DP so tey(till) you de get mouth say BBM sure pass 2go. She de send you sweet pictures, fused with soothing voice for voice-note your head don mad; you de ginger your guys say your shawty(girl-friend) confirm pass their own. Say dia own no near your own for anything; Bros you de say your woman wowo(ugly) fresh pass dia women finest. You de see her Ajebo friends de snap with her, so tey your guys want make friends meet friends. Na im you go arrange A.P with shawty for one garden near Leg Qtrs for Apo; you just posi(position) de wait for your first Lady. As you see her burst down from cab, you stand, arrange chair near you make physical conversation, and Love professing commence. All your guys de smile, while dia chicks(girls) de frown. All of a sudden d car wey(that) park dia just reveal 4 coti(police) from no where, ashei(notKnowing) the bebe involve 5o(police) for the matter. The babe begin scream 'officers catch him, he stole my phone' 'dats my phone he's holding'!!! On normal, you suppose just calm everything down unto say you be Big-Boy and kpata kpata(finally) you go sought ekelebe(police) 2k, dem(they) go free you. But your guys first cut-out(run) because dem carry enough exhibit for their body. Hug and possibly Kiss wey you for collect from fresh girl turn sour, as you too gas nack-out(run) based on excess exhibit wey youself carry; because if olokpa(police) hold you, 1: case don change. 2: na you with drugs(NDLEA) go reason the rest. Finally as a Bros, you settle everything, dem free your guys chicks. That one no do you Bros, you still buy another stolen.



Bros why you hate to give-up? Bros na from dere I begin fear you till now. Now my babe phone loss, I send invite to you upon the sure DP wey I put of one Igala model with fine face, and mature smile, you decline. 2months after I try again, with Pastor concept on DP and PM; you decline. I wait 5months to try again, you still decline. So after 8months, before I give up I say make I try 1 lasttest time. I send you invite you accept, I happy scatter. Den without wasting my time, you send me pics of me and my babe, me and my guys, my babe and her Mama. You come send me the baddest(worst) ping 'guy try give-up; this phone don go' na there I kindly delete you.
Which means you study and cram all the contact and conversation before you wipe the phone. Bros iHaiL.

Thank You

@pokesviille

1 comment:

  1. Baddest bros no b small tin o. Nice one Pokes. Can't stop laughing my ass out.

    ReplyDelete